Saturday 10 January 2015

NIGERIA and the Election WAHALA - WAZOBIA

ELECTION WAHALA




1. the bros dey try o... se as im just de use our man for govment, check dis guy now ...eehhh...ehh,ejehirika, dt bros been de dere for four years...real majo man, him been de run things... what of that confam yoruba guy...errrmm... errrm...men, i don forget him name...him from Abeokuta...ehen Him name na DONALD OKUPE...u see say Bros JONA na real man... him sabi how to engage alll man them...the bros de try...

fast foward to elections campaign plus preparation for the real elections.....

2. Oboy ye...dis moments are risky... baba, come o...u sabi APC... I here say na dem de ginger Boko Haram... Oboy no be little somthing o...how Boko Haram go wan be President... I swear I no fit follow dt kain person talk o...ahan... e go be sha...me I no wan know wetin de happen, all I know be Say na PDP for life....Ahh..PDP FOR LIFE O...NO shaking. Ehen Bros u still be Enyimba Fan? bcos me I don tire to de support enyimba...d last time we go watch match, i been wan buy Jersey and dem no get...E TOO PAIN ME.

3. But bros come o...dt APC wey u been de talk of, my senior bros for shop been talk say na dem get LAGOS..rremember dt time wey we been de try hustle lagos runnings wey things been no click...hmm... if NA APC GET LAGOS...I NO MIND IF DEM GET ABUJA TOO O...I hear say for abuja say people de run major major things. and this time i been hear say the APC PRESIDENTIAL LEADER NA FORMER SOULJA, abi General, say wen d guy been de office say im do many things like:

------1 naira = 1 USD..... e be like say Naira strong pass dt time...but i no too sure

------road been de new... even night journey been de safe...accident no too many

-----dem talk say d guy borrow money to buy presido candidate form...(d guy n dead guy o)

Anyhow Anyhow...person wey make 1 USD -= 1 naira....my man, na dt guy be d way... dis days naira don too de useless even to buy bread na struggle. if u enter market pple go de halla price for ur head because dem talk say dollar don increase.

my broda...i don talk my own finish...Walahi me na 1 USD = I Naira I de vote for.. Nna brodaly...wat about u... U go still vote BROS JAY? ahh my brodea wat are you talking... na Azikiwe all d way o.. but business is hard.. nna na 1USD = 1naira i de vote.. i close my eyes make i no remember APC ...but i go vote APC with eyes Closed.

heyce...come yoruba man...nbati nbati...I know say ur own no get competition...u de vote APC ABI? hmm dt useless APC we demolish our family house for Sagamu...i no like dem o...but dem de work...anyways me sef go close eyes VOTE APC...

United we stand ....what we need is good quality of life... not religion...not tribal sentiment.... as a nigerian i know we all hate each other...but we also love each other...we are the only Nation in the World allowed to love and Hate the Citizens.

Vote rightly...Vote for Equality...Vote for African Liberation...because if Nigeria achieves its former status quo of 1USD = 1Naira...den d World will respect Africa.